Wednesday, 19 December 2018

ICPC docks Deputy Director for allegedly defrauding unsuspecting job seekers of N8.8 million


The Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) don charge one Deputy Director wey dey with the Federal Character Commission (FCC), wey him name na Mr. Ahmad Balarabe go court as them talk say him don scam people way dey look for job of 8.8 million naira.
The Commission, for two-count charge wey them bring before Justice Bello Shinkafi, for Zamfara State High Court,

Keke Napep driver finds N1.1m in his car, returns it to the owner



Them don celebrate one Keke Napep driver wey find N1.150, 000 wey person one business man forget inside him keke. They say as this man see the money say him  return am to the owner of the money for Taraba state.

One  Twitter user wey him name na Isaac Onyema Ugo wey been share this story online talk say the businessman been

Apprentice fakes own kidnap to defraud boss of N500,000 Ogun State



Dem don arrest one apprentice wey dey Ogun state as im bn arrange fake kidnap make im collect im Oga #500,000 wey im suppose put for bank. According to wetin Punch Nigeria talk, this 18 year old boy wey im name be Adeboye Michael, go lodge imself for betta hotel come finish the money

One chance' operators arrested with fake US dollars and charms in Ogun State


Dis na Celebration period and many people wan do by force by force make dem celebrate with wetin dem no fit afford na im plenty bad tins dey happen for dis kin period. So make people dey shine their eyes well well becos peple no dey smile again o.

39-year-old man dies while hospital waited to receive bank alert before commencing treatment on him in Rivers State


Dem say wen life dey, hope too dey but some people no dey value life at all and e shock us say d people wey suppose get value for life, na dem dey take am do anyhow.

For Port-Harcourt wey dey Rivers state, one 39- year old man don die because d hospital wey im go no quick treat am after some area boys bn attack am.

men arrested for raping and killing woman they lured to hotel


the ogbonge police comman wey stand for inside Anambra state done catch two pipo sake of say dem been take kankara knowledge kon kpai one woman wey dem carry go inside hotel.

The Anambra State Police Command has apprehended two murder suspects for allegedly raping and killing a woman they lured to a hotel.

Maiduguri residents protest against 24-Hour electricity daily, demand reduction Borno State

Contry pipo wey dey stay for inside Maiduguri , wey be the Borno state capital don commot dey talk say dem no want 24 hours light wey dem dey get ooo say e too much make dem stop am.

As dem take talk, them say as dem too dey get light so na so the moni wey dem dey pay dey plenty well well. Dem come say dey want make Yola Electricity Distribution Company (YEDC) reduce the way dem too dey get light, say make dem reduce am back to 12 hours wey dem been dey enjoy before.

Tuesday, 18 December 2018

9-year-old boy drowns in an open well in Kano State


wona kukuma sabi say no be today we don dey drow ear give both parent and anybody weh get pikin to the shine eyes for their pikin for anything weh them the do or weh them the go

see now as yesterday weh be Monday, one nine-year-old boy weh them identify as Haliru Abdullahi go fall for inside open well for Kofar Kudu inside Gaya Local Government Area for Kano State.

Police kill two kidnap, robbery, cattle rustling suspects skokoto


Sokoto State Police Command don kill two notorious kidnapers, cattle rustling and robbery suspects, including one ward head for Gidan Bunu village for Rabah Local Government.

Na like Nineteen suspects, including one woman, na him them arrest for one villages across Goronyo, Rabah and Illela local governments.

The Items weh them recover from the suspects include 251 sheep, 69 cows, 29 camels, 98 blankets and seven wrapper.

Mentally ill man takes over primary school, attacks pupils, teachers Ekiti

When betta security no dey some important places, anything fit just happen as many tins go dey go wrong.

For AUD Primary School wey dey Irona, Ado-Ekiti, one mad man don chuk d lives of both the teachers and pupils wey dey there inside danger as im come turn the school to im personal property. This man don dey stay for the school without rent. The guy don

Fake prophet arraigned for alleged N2.4million fraud in Enugu State


As we wan take commot from Enugu State, na im Human Rights Radio bn hear anoda chuen chuen. Na im we come say make we go know true true wetin happen.


Hmm! The Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) wey dey Enugu branch don carry one Kingsley Ifeanyi Eluma (aka Doctor Eluma) go court for 17th December, 2018. Dem bn carry this Doctor Eluma, wey be the managing Director of EEAL Global Links Nigeria Limited, make he go answer im name for where Justice A.M. Liman of Federal High court Enugu, dey. Dem come give am two-count charge as im bn wan scam person of two

Youth corper arrested and remanded in prison for planning £12.5m scam


As our people dey talk, pikin wey no want make im mama sleep, no go sleep too. The way wey yahoo yahoo business don get company for Nigeria with plenty branches, dey surprise persin sotey e don turn to normal tin for young people especially d young guys wey we get.

For Enugu, dem charge one Ogbonna Victor Chibuzor for court as im bn try scam persin wey suppose give am 12.5 million pounds. We for human rights radio bn dey try grab d full chuen chuen when we come hear say the guy na corper. As im dey try corp d kin money from im victim,  na im EFCC wey be Economic and

Girl dies after being detained by hospital over unpaid medical bill Anambra State…


One sickle cell patient wey her name be Onyinye Ezeanyika, don die yesterday morning for one mission hospital for Onitsha, after d hospital management being hold am for there, because say her and her family no fit pay the hospital money for treatment…
According to DAILY POST, we gather say Onyinye  been dey there, reach one year and six months as the hospital no gree release am, because her and her family been never pay the hospital money wey reach N1.2million
The coordinator of the people Living With Sickle Cell Disorder, PLWSCD, Mrs Aisha Edward wey disclose this matter talk say, Onyinye die for the hospital where dem hold her hostage and na the hospital management do this kind wicked thing.
She disclose say Onyinye been done sneak commot for the hospital about a month ago to her house so  that she go fit show her the bill wey the hospital give her.
“She say, I been give her money by then and I even advice am say make she escape from the hospital. But when the hospital discover say she been done visit me, dem come dey threaten her, na him she come dey fear. But since then, Onyinye no get herself again….
“She even tell me say the hospital been dey plan to keep her there until Christmas when better people wey dem dey call Philanthropists dey come around to pay bills for patients wey no fit pay their bill. Na the motive wey the hospital been get, wey dem hold am for the hospital till she die….”

Cute New Born Baby Rescued After Being Dumped At The Roadside In Ogun State


Na wa o! People no dey fear God Again!  Pikin wey some people dey fast and pray to get, wey others dey travel go heaven come back dey look for, and wey others fit do anything to get, na him another person dey throway without  conscience… Just this morning, people find one small new born pikin wey dey alive inside black bag as the Mama or the person wey carry am abandon the pikin for roadside for Ayetoro inside Ogun State…  Na for side of the road people find this pikin after dem don abandon am just like that… Chai!

‘I am guilty'' - OAU sex-for-marks lecturer, Professor Akindele tells court

Prof. Richard Iyiola Akindele, way be former lecturer for Obafemi Awolowo University, Ile Ife, dey curt as them dey try am for the case of say him ask one girl wey her name na Monica Osagie for that thing, so him go give them mark.  Him Don talk say true true say him dey guilty of watin them say him do.

When them been table the matter on Monday, December 17th, Akindele been talk say him no dey guilty, but now him don change mouth, come talk say him dey guilty of watin them talk say him do.

Man crushed to death on walkway, another loses leg as car rams into shops in Lagos


Three men wey just dey comot from club around NNPC depot for Ejigbo, Lagos State on Sunday night, wey them suspect say dey high. been loose control of their white Toyota camry wey them dey drive . Them come jam and kill on man, wey them say dey find work for Kudirat Adenekan Street, Oke-Afa for around 11:00p.m. another person wey dey stand for the road  break him leg.
We hear say this two victims been just dey waka on their own when this moto loose control come jam them, come also jam some shops before the moto come somersault three times come land for middle of the road.

As some people talk, they say the accedent happen because off say the boys wey dey the car don high. Some other people talk say na the break been fail, and say the moto been dey on high speed
Even though say the man wey this moto kill been see as the car been dey somersult, him come run comot for road go stand near the shop wey dey by the side of the road, but this moto still somersault come met am for there, come kill am.

3 Ladies Publicly Disgraced After Being Caught Stealing Cloths In A Boutique In Uyo


Dem done disgrace three ladies sake of say dem go thief cloth for one boutique, According to report wey dey reach us for Uyo inside Akwa Ibom state. The girls been pretend say na customers dem be, naso one of the staff for the boutique come dey suspect there movement till him come catch dem koro koro as dem dey thief.

Osun Ogboni Fraternity Vows To Kill A 36-Yr-Old Man, Gbolahan & Family For Refusing

The leaders of ogboni pipo wey dey for inside Osun state done use hand nack chest say dem go kpai one 36 years old man wey him name be Owolabi Quardri Gbolahan, him wife and him children sake of say them no gree take oath, and him no gree take him father position inside the cult and say him no gree bring him wife and him daughter for circumcision.

Monday, 17 December 2018

Suspected ritualists steal three-year-old boy in Delta

Them don stele one three-year-old boy for Umunede, Ika North-East Local Government Area for Delta State.
This tori weh an Southern City News cari come, the say the parents of this pikin comot from house on Friday, come the pikin for the hand of him brother to look after am, But the time weh them go com back, them no see the piki8n again oooo.

Notorious cultists, armed robbers arrested in Bayelsa State

The Bayelsa State Police Command don arrested two suspected cultists, robbers for Bayelsa state come recover some firearms from them.
Talk talk person for for the commad, DSP Asinim Butswat, weh confirm the arrest on Friday, talk say them been gbap the suspects for weh them the do Stop and Search Operations weh na the operatives  for  Yenagoa metropolis cari am out.

Di Vigilante Wey Dey Kill Pipo For Zamfara Markets

Some pipo no dey go market again for Zamfara State, north west Nigeria as e be say one vigilante group wey dem call demsef ‘Yan sa-kai’ don kill many for di markets wey dey di state in di name of searching for thieves.
Jangebe market for Talata Mafara local goment dey among di major markets wey dey mostly operate on Sunday.
Fulani and oda tribes wey dey patronise Jangebe tok say Yan sa-kai group dey enter di market arrest pipo wey according to dem get links with thieves before dem kill dem.

killed my neighbours son because his dad damaged my womb – Lady Lagos State

Hmmm another wonder don happen for lagos state o! Chinenye Ndubuife wey yesterday, take vex massacre her neighbour 2-yr-old pikin, don talk say she do dis thing because the pikin papa na him damage her womb… Chai!

Trailer loaded with cows kills three people, injures 24 others

Three people don waka commot for this world wey we dey while them carry 24 people wey get different kind of injury go hospital becos of one accident wey happen with one trailer wey dey loaded with cow for along Kalgo-Jega road inside the state.
The News Agency of Nigeria (NAN) talk say that trailer wey cow full inside been dey move go lagos from Birnin Kenni wey be the state capital when the accident come happen on Saturday afternoon
One person wey dey there wey see am as e take happen ,Saidu Ibrahim, tell News Agency of Nigeria say the accident happen because the tyre of the trailer been burst.

Suspected female robbers battle police in hotel father

Nothing less than 10 people wey dem suspect say na robbers for weekend start to dey do shoot me I  shoot you with police for inside one hotel for Ogidi inside Anambra State.
The suspects wey two women join been dey operate for the hotel when dey police arrive after the information wey them get from people.

How we would have made N500m from kidnapping this December - Kidnapper opens up in Abuja

The operatives of thye IGP intelligence response team don aresst one sani mohammmed wey be member of one 5man kidnap- gang , mohammmed sani talk say they for don make up to 500,million naira from kidnaping of people wey get money for Abuja and kaduna this December if dem be knw aresst am

Former militant’s brother killed by kidnappers while trying to pay ransom

Kidnapers don kill One before before militant brother for along onuebum –otuogori road  for inside ogbia council of bayelsa state as dem be wan pay the kidnapers money.
A former militant’s brother was killed kidnappers along the Onuebum-Otuogori road in Ogbia council area of Bayelsa State, while trying to pay a ransom.

Two friends bag 6-months jail term for obtaining by 'fraudulent trick' in Edo State

EFCC for benin don confirm the conviction of two 419 boys for the Federal High Court sitting for Benin City,  Edo State. Them been charge Emeodi Chuks with one count charge for collecting money with curney corney..
Emeodi agree say him dey guilty of the charge. The judge come give am six months imprisonment for him offence.

40-year-old kidnaps 3-year old girl in Niger state

The Niger Police Command don arrest  One 40 years old okada man wey him name na, Salisu Abdullahi, wey them say kidnap one 3 years old pikin for Dutsen-Kura Gwari for Minna, wey be  the state capital.
We hear say the mama of the pikin been tell the okada man say make him carry the girl go Police Children School wey no far from the house. But instead the okada man been carry the pikin run.
For one interview with Northern City News on Sunday, Abdullai talk say him no know watin make am do this kind thing. Say e be like say na remote control them use ontop am.

50-year old commercial bus driver beaten to death with charm in Ondo State

For Ondo state some area boys beat one 50- years old bus driver, wey im name be Akeem Olanipekun, sotey im come die. This gbese bn happen for Imo quarters for Ondo state this weekend wey just pass.
According to the chuen chuen wey we get, these area boys beat dis man with charm wey dem hold. People wey see wetin happen talk say the man just follow im friend wey get renting business as dem go set canopy for one ceremony wey wan happen. The person talk say as dem dey set the canopy, na so the area boys gather dem dey ask for money, wey dem dey call “owo ile” before dem go set the canopy.

Abia man butchers his wife then commits suicide by setting himself ablaze

E get one man for Isiukwuato Local Government for inside Abia State wey kill imself as im take fire finish imself. This man wey im name be Ejike bn get quarrel with im wife na so he take use cutlass sama d woman for inside Ezere, wey dey Abia State. As people see wetin happen, na im dem carry am go hospital and as she dey so, her case dey very serious.

Woman found dead in Ebonyi hotel room, her boyfriend arrested

Many tins don dey happen for dis country wey we dey so o. na im we dey tell people make dem dey shine their eyes make all dis bad bad tins no near dem.

For Crown Garden Hotel wey dey along Afikpo road inside Abakaliki wey dey for Ebonyi State, na dere dem find d dead body of one woman on Sunday wey be 16th December, 2018. This tory bn reach us through the police talk talk person wey dey Ebonyi State Police Command, wey be DSP Loveth Odah.

Simple Affiliate System - New For 2022

  Simple Affiliate System Review – What to Make of the Program? Click here https://1b9b7yz7ul-pv0xgpgqffxl85w.hop.clickbank.net/ People nowa...