the ogbonge police comman wey stand for inside
Anambra state done catch two pipo sake of say dem been take kankara knowledge kon
kpai one woman wey dem carry go inside hotel.
The Anambra State Police Command has apprehended two
murder suspects for allegedly raping and killing a woman they lured to a hotel.
As police take talk, on Monday wey be
17/December/2018 as police take get information the police detectives wey join
body with central police station for inside Onitsha been arrest this pipo wey
therir name na one okoronji Emeka wey be 24 years and one Umezinwa Val wey be
24 years.
This bad pipo on 5th December 2018 been
use cunny cunny carry one Gold Gift wey be 35years go one hotel come kill her
after de,m done get kankara knowledge with this sisi.
As police pipo put eye inside dis issue dem been observe say na one hotel staff carry the
dead body go keep for BSMG roundabout for inside Onitsha and the staff no tell
police.
Naso police come arrest 3 of the hotel workers
including the manager wey him name na Ekene Gabriel, the bar man wey be Tom
Bishop Emmanuel and the gateman wey him name na Arume Ifeanyi Godwin.
Police still dey put eye for the case and after dem
tourch light am well well dem go carry the pipo go court make dem face the law.
No comments:
Post a Comment