Some pipo no dey go
market again for Zamfara State, north west Nigeria as e be say one vigilante
group wey dem call demsef ‘Yan sa-kai’ don kill many for di markets wey dey di
state in di name of searching for thieves.
Jangebe market for Talata
Mafara local goment dey among di major markets wey dey mostly operate on
Sunday.
Fulani and oda tribes wey
dey patronise Jangebe tok say Yan sa-kai group dey enter di market arrest pipo
wey according to dem get links with thieves before dem kill dem.
Di pipo tok say dis
development don skata di economy of di place and put serious fear in di mind of
pipo wey dey stay di area.
To make mata worse,
Zamfara police command yan say dem no dey aware of dis issue.
Di tok tok pesin of di
command SP Muhammad Shehu tell BBC say dem no dey aware of dis but dem dey try
dia best to make sure say security good for both towns and villages wey dey
Zamfara state.
Di state goment tok say
dem dey try dia best to solve dia problems even though some pipo believe say
dem get hand for di issues wey dey go on but di goment deny dis allegations.
Oga Shehu add say because
of di security challenge wey di state, e good make pipo dey call dem if dem see
anything suspicious or wan give advice on anything.
Di issue of thieves and
kidnapping for ransom dey increase for di state despite security trying to
bring end to dis problems
No comments:
Post a Comment