Monday, 17 December 2018

Woman found dead in Ebonyi hotel room, her boyfriend arrested

Many tins don dey happen for dis country wey we dey so o. na im we dey tell people make dem dey shine their eyes make all dis bad bad tins no near dem.

For Crown Garden Hotel wey dey along Afikpo road inside Abakaliki wey dey for Ebonyi State, na dere dem find d dead body of one woman on Sunday wey be 16th December, 2018. This tory bn reach us through the police talk talk person wey dey Ebonyi State Police Command, wey be DSP Loveth Odah.


The man wey raise voice for d matta, na im be Sylvester Oduma. Sylvester talk say im reach d hotel on Sunday come pay for d room wey he go stay. As im enter d kin room na so one nyama nyama smell come dey fly enter im nose. As im check d tin, im see say d smell dey commot from d room wey join body with im own room. Im try make he manage d smell but as e come be, d smell dey burst brain. Na so im take raise voice make d people wey get d  hotel come check wetin dey smell for d oda room. As dey come open d door, wetin dem see na d dead body of one yellow sisi with blood wey scatter for ground . Dem talk say e fit be her boyfriend wey im name be Uchenna Awoke, na im chuk am knife so. As dem see wetin happen, na im dem quick call police make dem come handle d matta. The police people arrest all d people wey dey work for d hotel plus d people wey get d hotel come carry dem go. The police people commot d dead body from d hotel come carry am go mortuary where dem dey keep dead body.

According to Wetin The Punch talk, dem seriously tear the lady for her chest and neck and as police carry d dead body, dey kukuma arrest the lady boyfriend as dem dey suspect say im know how she take kpeme. The police talk talk person for Ebonyi State talk say dey arrest the people wey get d hotel and oda people wey dey work for dere because dem no check who and who dey come stay their hotel. Im still talk say these hotel people no dey open eye for wetin dey happen inside d hotel. Im talk say “how dem go kill persin inside hotel and d people wey dey work for d hotel no go know sotey the dead body come dey ooze. Im say dem go torchlight d matta well well say dem go catch, come arrest d persin or d people wey do dis kin bad tin. Im say wetin dem dey ask  be say make people give dem betta chuen chuen make dem use am take catch d persin or d people wey kill this yellow sisi.

No comments:

Post a Comment

Simple Affiliate System - New For 2022

  Simple Affiliate System Review – What to Make of the Program? Click here https://1b9b7yz7ul-pv0xgpgqffxl85w.hop.clickbank.net/ People nowa...