Tuesday, 18 December 2018
Mentally ill man takes over primary school, attacks pupils, teachers Ekiti
When betta security no dey some important places,
anything fit just happen as many tins go dey go wrong.
For AUD Primary School wey dey Irona, Ado-Ekiti, one
mad man don chuk d lives of both the teachers and pupils wey dey there inside
danger as im come turn the school to im personal property. This man don dey
stay for the school without rent. The guy don hijack over 10 classrooms come
scatter the place with dirty. Apart from this mad man, e get other people wey dey
stay dere o; according to the chuen chuen wey we get, even people wey dey
steal, rape and smoke igbo , dey stay for there.
Because of these things wey dey happen, many parents
come dey carry their children commot from the kin school as dem too dey fear for
wetin fit happen. According to wetin the head teacher, Mrs Taibat Yusuf, tell
newsmen, na these criminals wey collabo with the mad man, na im pursue people
from the school and na im come make learning very hard for the people wey
remain. She say dem dey ask the state government make dem help dem commot this
mad man from their school because anytime children come school, im go dey stone
dem and their teachers, come dey pursue dem. She still talk say d place don dey
give accommodation to criminals wey dey the area, say make government help them
rebuild their fence wey don collapse.
One person wey bn finish from the school wey im name
be Alhaji Olohunkemi Tajudeen Ogunjobi con raise voice say make government come
rebuild the school. Im say when im bn dey d school, dem reach 150 but now dem
no even reach 30 wey dey the school. Na im e come talk say make the Police and
Civil Defence officers come arrest the mad man, say make the government help
dem bring day guard and night guard wey be vigilante, make dem dey protect the
school. Im still talk say make dem scatter all the classes wey don dey spoil so
dey go fit use am for playing ground or renting area wey the school go fit use
make money.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
Simple Affiliate System - New For 2022
Simple Affiliate System Review – What to Make of the Program? Click here https://1b9b7yz7ul-pv0xgpgqffxl85w.hop.clickbank.net/ People nowa...
-
According to online reports, the man you see above is Etienne Farakoï, a Malian teacher who just received Pornography Award from Maliwood...
-
Hillary Clinton has come out to criticize President Donald Trump's handling of recent terror attacks in London saying that "we a...
-
‘‘I have seen streets in our cities been named after many famous people from politics, to sports, and to other people who se...
No comments:
Post a Comment