Wednesday, 19 December 2018

One chance' operators arrested with fake US dollars and charms in Ogun State


Dis na Celebration period and many people wan do by force by force make dem celebrate with wetin dem no fit afford na im plenty bad tins dey happen for dis kin period. So make people dey shine their eyes well well becos peple no dey smile again o.


For Ogun State, The Nigeria Police Force, zone 2 command, don gbab four people wey dem dey suspect say dem dey do wetin we dey call “one chance’. Dem catch dem through the Criminal Investigation and Intelligence Department wey dey that area.

For 27th November, 2018, na im one Mr Onyekwere bn carry cry come police say e get some people wey don dey collect money from im wife, say im suspect say dem be 419 people. As the matta enter police ear, na im the Assistant Inspector General wey dey Zone 2 command, AIG Lawal Shehu, come carry plenty torchlight chuk for the matta. Na so dem take gbab Babatunde Adeyemi wey be 26 years, Lawal Amoke wey be 40 years, Oluwabunmi Okeomo wey be 45 years and Ogaode Monday wey be 25 years as dem see say dem get hand for inside d matta.

As d torchlight come dey shine for d matta so, na im dem find #91,000, 900 fake US dollars, one Honda Accord Motto wey im plate number be MN 783 AAA and some juju wey dem carry.

The wife of the man wey raise voice for the matta talk say she bn enter the car and as dem come dey go, na im dem talk say dem go introduce am to one phone business and as she dey do the kin business, she say she don get up to 1.5 million naira before her husband come know wetin dey happen, come raise voice.

These people wey dem arrest get shrine wey dem get along Ifo wey dey Ogun State. Police don scatter d place, say dem go carry these one chance people go court.

No comments:

Post a Comment

Simple Affiliate System - New For 2022

  Simple Affiliate System Review – What to Make of the Program? Click here https://1b9b7yz7ul-pv0xgpgqffxl85w.hop.clickbank.net/ People nowa...