Dem say wen life dey,
hope too dey but some people no dey value life at all and e shock us say d
people wey suppose get value for life, na dem dey take am do anyhow.
For Port-Harcourt wey
dey Rivers state, one 39- year old man don die because d hospital wey im go no
quick treat am after some area boys bn attack am.
Na one popular Rivers
state comedian wey be KO baba, come raise voice for the matta as im carry cry
come internet. Im talk say the man wey die, wey im name be Progress Dennis bn
dey come back from church with im friend after their thanksgiving service. As
im come reach Atillery road, na im some area boys come rush am. People come
carry am go Datta Medical Center but as dem reach the hospital, the hospital
people talk say dem no go treat am until dem drop 25k wey be #25,000. Dem come
do online transfer of #30,000 to the hospital but the hospital people still
talk say dem no go treat am till dem get d alert.
As dem dey do all these
ones, na im blood come dey finish for Progress body sotey im come die. Dem come
bury am but all the paddi wey Progress bn get dey talk say dem go sue the
hospital say their friend no go just die for nothing.
Hmmm!
No comments:
Post a Comment