Monday, 17 December 2018

killed my neighbours son because his dad damaged my womb – Lady Lagos State

Hmmm another wonder don happen for lagos state o! Chinenye Ndubuife wey yesterday, take vex massacre her neighbour 2-yr-old pikin, don talk say she do dis thing because the pikin papa na him damage her womb… Chai!

We gather say Ndubuife, wey dey live with her Mama for the same compound with the married man, Samuel Promise, been don hit the pikin for wall with him head before she use big stone take scatter am… Hia, people get mind o!
Na so the suspect come carry the pikin body go dump am for inside toilet… According to our sources, the suspect been dey bitter against the boy father as she hold am for mind because na him papa make her do plenty abortions for am when dem been dey get secret touch-touch relationship.
When dem catch her, the woman tell police say she lost her womb because of the plenty abortions wey she don do for Mr Promise and she been want make him also feel the pain and make him spend money to treat him pikin…
She talk say na only small wound she been wan give the pikin, but she no get choice but to dump him body when she come discover say the pikin don die… Confirming the matter, Police  talk-talk person wey him name na Chike Oti, talk say dem been report this matter for trinity police station and dem go take am from there

No comments:

Post a Comment

Simple Affiliate System - New For 2022

  Simple Affiliate System Review – What to Make of the Program? Click here https://1b9b7yz7ul-pv0xgpgqffxl85w.hop.clickbank.net/ People nowa...