Tuesday, 18 December 2018

Girl dies after being detained by hospital over unpaid medical bill Anambra State…


One sickle cell patient wey her name be Onyinye Ezeanyika, don die yesterday morning for one mission hospital for Onitsha, after d hospital management being hold am for there, because say her and her family no fit pay the hospital money for treatment…
According to DAILY POST, we gather say Onyinye  been dey there, reach one year and six months as the hospital no gree release am, because her and her family been never pay the hospital money wey reach N1.2million
The coordinator of the people Living With Sickle Cell Disorder, PLWSCD, Mrs Aisha Edward wey disclose this matter talk say, Onyinye die for the hospital where dem hold her hostage and na the hospital management do this kind wicked thing.
She disclose say Onyinye been done sneak commot for the hospital about a month ago to her house so  that she go fit show her the bill wey the hospital give her.
“She say, I been give her money by then and I even advice am say make she escape from the hospital. But when the hospital discover say she been done visit me, dem come dey threaten her, na him she come dey fear. But since then, Onyinye no get herself again….
“She even tell me say the hospital been dey plan to keep her there until Christmas when better people wey dem dey call Philanthropists dey come around to pay bills for patients wey no fit pay their bill. Na the motive wey the hospital been get, wey dem hold am for the hospital till she die….”


Edward say the thing wey dey pain her now be say, the hospital wey dey involved na missionary hospital fa!
She come  lament say  hospitals dey purposely use sickle cell patients, as dem go charge them very high so that these Philantropists and other concerned organizations fit come pay, so that dem fit see small chua chua money take put for pocket… Chai!

Speaking on the sickle cell patient wey just die, Edward say, “I been call her the day before yesterday say make she come join us for Onitsha where one NGO been donate food items and different-different gift dem to us plus including entertainment but she been tell me say she no fit come because her body been dey pain am seriously…

“I even bring some foodstuffs back so that I go fit share to some members wey been no fit make am come Onitsha, but I shock when I come hear yesterday say she don die…

“Now  wey she don die, make the hospital sell her body na, so that dem go fit pay the bills wey she no fit pay… Na so Edward talk, as she dey cry…

No comments:

Post a Comment

Simple Affiliate System - New For 2022

  Simple Affiliate System Review – What to Make of the Program? Click here https://1b9b7yz7ul-pv0xgpgqffxl85w.hop.clickbank.net/ People nowa...