Dem don arrest one
apprentice wey dey Ogun state as im bn arrange fake kidnap make im collect im
Oga #500,000 wey im suppose put for bank. According to wetin Punch Nigeria
talk, this 18 year old boy wey im name be Adeboye Michael, go lodge imself for
betta hotel come finish the money
on top woman. Dem gbab Michael with im
friends wey be Nafiu ojo and Abdullahi Lawal, as dem join for kin gbese. The
chuen chuen wey we get be say these im friends been pose as the people wey
kidnap Michael, wey be the apprentice. Dey come dey ask Michael Oga make im pay
1 million naira efore dem go release Michael.
The police talk talk
person wey dey Ogun state, DSP Abimbola Oyeyemi, talk say dem arrest these
people as Michael Oga wey be Oluwoju Abiodun bn raise voice for Oke-itoku
Police Station wey dey inside Ogun state.
Im talk say the plan
wey these guys bn get na to collect money from Michael Oga say as dem dey
torchlight the matta, these guys come see say dey go soon catch dem na im
Michael come form one tory wey im tell police but im no know say police come
dey find d people wey kidnap am.
As dem catch dem, na so the real tory come dey
commot. Dem come tell police say na the Michael been hire dem make dem do like
say dem kidnap am so that im go carry the #500,000 wey im oga give am make e go
pay for bank. As the real tory commot, na im dem arrest Michael, na there im
come confess say im go lodge for hotel with two girls come dey waste the money
for there. Dem collect the #120,000 wey remain from Michael and according to
the police talk talk person, the commissioner of Police for Ogun State, Ahmed
Iliyasu, talk say make dem carry dem go betta court as soon as dem finish to
dey torchlight the matta.

No comments:
Post a Comment