Dem done disgrace three ladies sake
of say dem go thief cloth for one boutique, According to report wey dey reach
us for Uyo inside Akwa Ibom state. The girls been pretend say na customers dem
be, naso one of the staff for the boutique come dey suspect there movement till
him come catch dem koro koro as dem dey thief.
As dem come catch dem, dey come see
some cloth wey dem been done hide, Naso dey come force dem make dem sit down
for ground, na there pipo come gather dey look and dey video dem.
As wey dey talk to you now the staff
of the boutique been dey reason to carry the suspect go police station. Naso
the boutique workers start to dey tell contry pipo say make dem shine there
eyes well well this Christmas period.
No comments:
Post a Comment