Contry pipo wey dey stay for inside Maiduguri , wey
be the Borno state capital don commot dey talk say dem no want 24 hours light
wey dem dey get ooo say e too much make dem stop am.
As dem take talk, them say as dem too dey get light so
na so the moni wey dem dey pay dey plenty well well. Dem come say dey want make
Yola Electricity Distribution Company (YEDC) reduce the way dem too dey get
light, say make dem reduce am back to 12 hours wey dem been dey enjoy before.
Some of d contry pipo wey dey stay for inside the
state capital, been do we no go gree waka go the YEDC office to tell dem say
dem want make dem reduce d way dem dey get light.
One of the pipo talk say, him bill show say him use
650 units for inside November and dem been tell am say him moni 14,000 naira while him pay 6,500 naira for
the same unit for inside September.
The business manager of YEDC for Maiduguri talk say
all this complain na becos of say dem just open one 330kV transmission line wey
go dey give dem 24hrs light, so d way the pipo dey use light done increase well
well.
No comments:
Post a Comment