Tuesday, 18 December 2018

9-year-old boy drowns in an open well in Kano State


wona kukuma sabi say no be today we don dey drow ear give both parent and anybody weh get pikin to the shine eyes for their pikin for anything weh them the do or weh them the go

see now as yesterday weh be Monday, one nine-year-old boy weh them identify as Haliru Abdullahi go fall for inside open well for Kofar Kudu inside Gaya Local Government Area for Kano State.

The talk talk person for Kano State Fire Service, Alhaji Saidu Mohammed say the incident happen around 9:00 a.m. as the boy been the play with him friends as him come go fall for inside the well.

As him the talk; “We received one sorrowful call for early mor-mor yesterday (Monday) from one  Hamza Abdullahi, for around 9:00a.m say one boy don fall inside well.

As we receive the information, we quickly sent our rescue team to weh the thing happen around 9:40 a.m. as them rescue Abdullahi but come later confirme say him don die. Them come hand over him body to Hamza Abdullahi,” na so the talk talk person come the talk.

Mohammed come still again the draw ear give parents, weh get wells for their hous, to the build am go up well well and to the put am cover so that this kind thing no go happen again

No comments:

Post a Comment

Simple Affiliate System - New For 2022

  Simple Affiliate System Review – What to Make of the Program? Click here https://1b9b7yz7ul-pv0xgpgqffxl85w.hop.clickbank.net/ People nowa...