Them don celebrate one Keke
Napep driver wey find N1.150, 000 wey person one business man forget inside him
keke. They say as this man see the money say him return am to the owner of the money for
Taraba state.
One Twitter user wey him name na Isaac Onyema Ugo wey
been share this story online talk say the businessman been
give the okada man
200 naira as him reward.
According to as ugo take
write am for twitter, him talk say.
Make we celebrate Mr Usman
wey be honest keke rider. one Businessman From The East been forget N1,150,000 inside
him keke him come stop him work go dey find this man so he go fit give am the money
for jalingo, Taraba State. As him return the money the man been give usman 200
naira for recharge card…
According to people wey
chook mouth for the matter for social media.
Ze prince talk say
As this economy hard reach,
person still get mind to return this kind money. This man na good man.
Oni olanrewaju Adebayo talk
say
Una fit imergin? 200 naira,
if the guy see this kind money another time, you think say him go return am?
Some people no just sabi appreciate person. Though say e good say him return
the money but that kind appreciation no be am.
One Nkiruka talk say
Some Nigerians still dey
honorable oh. Nake God reward this man.

No comments:
Post a Comment