Na wa o! People no dey fear God Again! Pikin wey some people dey fast and pray to
get, wey others dey travel go heaven come back dey look for, and wey others fit
do anything to get, na him another person dey throway without conscience… Just this morning, people find
one small new born pikin wey dey alive inside black bag as the Mama or the
person wey carry am abandon the pikin for roadside for Ayetoro inside Ogun
State… Na for side of the road people
find this pikin after dem don abandon am just like that… Chai!
Na so people dey shocked as dem find this pikin for the road
and ontop of that, the umbilical chord wey dey join mama and the pikin still
dey for him body, meaning say, e never tay when dem born dis pikin before the
Mama or whoever, come dump am for roadside… Meanwhile, the kindhearted
residents carry dis pikin comot from inside the bag, as dem come rush the pikin
go hospital for check up……
No comments:
Post a Comment