Tuesday, 18 December 2018

Osun Ogboni Fraternity Vows To Kill A 36-Yr-Old Man, Gbolahan & Family For Refusing

The leaders of ogboni pipo wey dey for inside Osun state done use hand nack chest say dem go kpai one 36 years old man wey him name be Owolabi Quardri Gbolahan, him wife and him children sake of say them no gree take oath, and him no gree take him father position inside the cult and say him no gree bring him wife and him daughter for circumcision.

This traditional cult group wey dey inside osun state been put owolabi Quadri Gbolahan family and some oda pipo name as enemies of the cult and dem talk say dem no go allow dem go  free like that.
Afta dem don kill chief mrs Florence owolabi wey be the mother of owolabi Quardri Gbolahan for inside march 2018 we here say dis ogboni cult pipo still kill Owolabi Kazeem wey be the younger brother of Owolabi Quadri Gbolahan.
As this report dey come to una so, we no no where owolabi Quardri Gbolanhan plus including him wife and pikin them dey. The place wey dem see dem last na for church for February 2018, and we dey hope and pray say mr Gbolahan and him family dey alright.
As e be like this we dey call on our security pipo make dem start to dey check wetin dis ognoni pipo dey do for area, make our life and property dey safe.

No comments:

Post a Comment

Simple Affiliate System - New For 2022

  Simple Affiliate System Review – What to Make of the Program? Click here https://1b9b7yz7ul-pv0xgpgqffxl85w.hop.clickbank.net/ People nowa...