Tuesday, 18 December 2018

Fake prophet arraigned for alleged N2.4million fraud in Enugu State


As we wan take commot from Enugu State, na im Human Rights Radio bn hear anoda chuen chuen. Na im we come say make we go know true true wetin happen.


Hmm! The Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) wey dey Enugu branch don carry one Kingsley Ifeanyi Eluma (aka Doctor Eluma) go court for 17th December, 2018. Dem bn carry this Doctor Eluma, wey be the managing Director of EEAL Global Links Nigeria Limited, make he go answer im name for where Justice A.M. Liman of Federal High court Enugu, dey. Dem come give am two-count charge as im bn wan scam person of two million, four hundred and fifty-two thousand, five hundred naira. When dem tell am wetin im don do, im talk say im no dey guilty.

Eluma don dey talk say im get PhD certificate, come talk say im be prophet. From the chuen chuen wey we gather, this Eluma bn tell dis person wey e wan scam say im be Director for National Information Technology Development Agency, wey be NITDA. Im join tell d person say im fit get work for am for Federal Civil Service Commission. Im collect betta money from dis person, come tell am say im go help am get Visa for im family members make dem use take go Dubai and United States of America, say im go still help am import one second hand Toyota Camry wey dey America.


Eluma lawyer bn talk say make dem give im client bail but the other lawyer talk say make dem no grant am b ail sake of say, he fit jump bail.


The judge wey sidon on top the matta come talk say the only way dey go grant am bail na if Eluma provide the sum of two million naira and one surety wey get land for Enugu state.

Justice Liman come shift the matta go 13th February, 2019 come talk say Eluma go dey inside prison until im bring all d tins wey d court talk say im go bring.

 


No comments:

Post a Comment

Simple Affiliate System - New For 2022

  Simple Affiliate System Review – What to Make of the Program? Click here https://1b9b7yz7ul-pv0xgpgqffxl85w.hop.clickbank.net/ People nowa...