As
our people dey talk, pikin wey no want make im mama sleep, no go sleep too. The
way wey yahoo yahoo business don get company for Nigeria with plenty branches,
dey surprise persin sotey e don turn to normal tin for young people especially
d young guys wey we get.
For
Enugu, dem charge one Ogbonna Victor Chibuzor for court as im bn try scam
persin wey suppose give am 12.5 million pounds. We for human rights radio bn
dey try grab d full chuen chuen when we come hear say the guy na corper. As im
dey try corp d kin money from im victim,
na im EFCC wey be Economic and
Financial Crimes Commission come gbab the
guy. As dem arrest am, e no tey before dem come carry am go court make he go
jam eye with Justice A.M. Liman for Federal High Court wey dey enugu charge am
for five crimes wey im commit inside the matta. Dem charge am with intent on
fraud because im even tink am to scam person, come charge am with possession of
fraudulent documents as im go forge documents so that the persin wey im wan
scam go tink say im dey legit. The judge talk say all the tins wey im do dey
against section 6 of the Advance Fee Fraud and Other Fraud Related Offences Act
2006 and e get im own kin punishment wey dey follow am.
Dem
arrest Ogbonna as dem take arrest other yahoo yahoo boys last week wey dem
catch plenty of dem wey dey live large without any legit work wey dem dey do.
Dem see say na laptop wey dem dey use well well. As dem check ogbonnay laptop,
na im dem see plenty documents wey im dey
use scam both oyibo people and Nigerian people. Dem come do serious
torchlighting for the matter come see say Ogbonna dey use one fake e-mail
address wey be activitygeneral@hotmail.com.
He dey use dis email address make im take send some kin pictures and messages
so that these people go tink say im dey legit.
One
of the documents wey dem see for Ogbonna Laptop show say im dey send one
message to one Alan Christopher of BG Group plc. Im tell d man say im attention
dey needed say im never come claim im contract money wey be twelve million five
hundred pounds Sterling. Another document wey dem find bn show say dem wan give
one contract to one Michael Morgan wey dey Brooklyn for new york wey dey
America as dem come dey pose as the chairman of the Contract and Tender
Board wey dey the legal department of
chevron Nigeria.
Ogbonna
talk say im no dey guilty for wetin dem dey charge am. He come talk say make im
lawyer wey be E.O. Isiwu apply for bail but the opposing lawyer come refuse but
the Judge come give am bail, say he must pay bail of #500,000 and one surety
wey go provide #500,000 too.
The
judge talk say, the surety wey dem go bring gats get land for Enugu and the Oga
wey dey in charge of land matta for Enugu State go check say true true the
person get land for Enugu State. Im still talk say dem go keep Ogbonna for
prison until im provide all d tins wey dem tell am make im provide. They don
shift d case go 30th January 2019 nd as e be so dis guy no go fit
enjoy dis Christmas well well like other people. Yahoo yahoo no be better work
o. take your life do better tin.
No comments:
Post a Comment