Monday, 17 December 2018

50-year old commercial bus driver beaten to death with charm in Ondo State

For Ondo state some area boys beat one 50- years old bus driver, wey im name be Akeem Olanipekun, sotey im come die. This gbese bn happen for Imo quarters for Ondo state this weekend wey just pass.
According to the chuen chuen wey we get, these area boys beat dis man with charm wey dem hold. People wey see wetin happen talk say the man just follow im friend wey get renting business as dem go set canopy for one ceremony wey wan happen. The person talk say as dem dey set the canopy, na so the area boys gather dem dey ask for money, wey dem dey call “owo ile” before dem go set the canopy.

From there na im hot quarrel burst between Akeem and these area boys. These area boys come commot go bring charm, use am take beat the man because he no pay them “Owo Ile”. After dem beat the man finish, d man come dey shake till he come finally die.
As tins be now, d whole town dey shake because of this matter. People dey fear say d family of d man fit wan revenge for wetin these area boys do the man.
People wey dey when e happen talk say as them beat d man finish, na im dem come tear race commot from the area. The oga of Police wey dey that area, Razak Rauf, talk say true true this tin happen. He come talk say dem go find these area boys come arrest them join. As e be so, dey don carry Akeem dead body go mortuary wey dey Ondo State Specialist Hospital Ikare Akoko

No comments:

Post a Comment

Simple Affiliate System - New For 2022

  Simple Affiliate System Review – What to Make of the Program? Click here https://1b9b7yz7ul-pv0xgpgqffxl85w.hop.clickbank.net/ People nowa...