Nothing less than 10
people wey dem suspect say na robbers for weekend start to dey do shoot me
I shoot you with police for inside one
hotel for Ogidi inside Anambra State.
The suspects wey two
women join been dey operate for the hotel when dey police arrive after the
information wey them get from people.
The nation gather say
the suspect them been lock the hotel gate as dem see say our ogbonge police
they come , before you know dem start to dey shoot police oo this shoot shoot
last for more than 30mins.
Person talk say one of
the suspect been get serious gunshot injury as him been whan collect one police
officer arm, them later arrest am and two female robbers wey dey receive
treatment, but the remaining robbers been escape.
Police spokesman wey
him name na Haruna Mohammed confirm the incident as him take say them arrest
six of the suspect, as the people wey give them hand escape.
Him talk say dem
recover one local made pistol, 3 live
cartridges, one axe, two empty shells, some quantities of dried leaves wey dem
dey suspect say na indian hemp and tramadol drugs.
Mohammed talk say
around 4 in the evening na him dey get the report for Ogidi division say some
suspected robbers/cults been dey for inside paradise hotel for inside ogidi,
him say na so some detectives wey join body for ogigi division run go d place.
Him talk say one of the
suspect wey him name na Ugochukwu Okafor get gunshot wound for him nyansh while
him one collect the police man gun.
He talk say them dey tourch light the mata
No comments:
Post a Comment